Wetin you be
Wey you no fit cool down
About, about you dey bisi body
I be this, I be that.
Wetin you be
Wey all you sabi na to razz around
Blowing your trumpet like say
Na you owe Wall Street.
Wetin you be
Wey all you sabi
Na to blow cut and joint grammar
Come dey pose like Guinea fowl.
Abeg wetin you be
Wey small change dey swell your head
Tell me, wetin you be sef
Wey you want take oversabi kill your sef o!
�Nsikak Andrew, 26th September, 2007