Pooh! Pooh!!



Pooh!,
I say who mess?
Pooh!, Pooh!!
I say who messes?
Pooh!, Pooh!!, Pooh!!!
I say who messes?

For West, if you mess,
Dem go shout sori � o!
Say him no wound you.

For South, if you mess
Dem go shout insult
Infact, punishment fit follow.

For East, if you mess
You fit take Ego
Buy your freedom.

For North�
No ask me o
Make you go ask Abogi.

Pooh!, Pooh!!, Pooh!!!
Na so our mess dey cause go-slow
Before you know, all face go squeeze
Like shit wey dem match.

Pooh!, Pooh!!, Pooh!!!
Abey, na which direction
They mess come from?
 
 
Nsikak Andrew, 15th August, 2007

Share this

Related Posts

Previous
Next Post »